My school and I : Deadline extended, after all the wahala.
Omo why this week come be like this na? Tolu said as he entered the room.
"You don come back?" Hassan said laughing as tolu entered the room.
"Mtchew. Abeg leave me. Tolu replied
"Omo!!" Hassan laughed hard.
"If person say make you people they calm down una no go hear" Hassan said.
"The thing no funny at all. No dey laugh again" Tolu said in anger.
"Sorry o. When I dey tell you say make you calm down sey UI fit shift the deadline you no hear. I tell you say them go consider everyone as per say the portal sef kon dey do yama yama the minute them release that bulletin say as from Monday we go dey pay ₦5000 for late registration. Shey e no Ko n be like that?" Hassan asked.
"You no dey okay. At all. Omo see this guy o. You wey don pay school fee, don do your course registration, before them even release bulletin you tell me say make I know worry them go extend the deadline without penalty and you kon expect me make I really calm down? Shey you dey okay sha? Abeg no add to my frustration at all. Mtchew" Tolu replied.
"Ehnn shey them no kon shift am? See the thing wey me dey tell you yesterday and this morning, be say make you dey calm down ehn. E no be your fault sey you no get the money on time Na and when you kon get the money sey you wan pay, the portal kon get problem. E no be your fault, so in some situations
ehn, you gats to be calming down.
"Guy wetin you dey talk na?? How you expect me make I calm down in that kind situation now?? No be say I get one extra 5k somewhere, sey I fit do late registration. You dey tell me nonsense. I kon get the money before deadline gan gan say make I pay, do course registration, the portal kon get problem and the deadline na the next day. You no know wetin you dey talk at all. If them no kon shift am without penalty nko? Na me go dey stress to get another 5k for late registration? You no know how e dey go at all"
"Sorry no vex. Shey you don pay the school fee now and you don do registration?"
"Na on top how we go submit the course registration we dey with the way the portal dey do, John message me say them don extend the deadline till 30th of April. I thank God say them shift am but the stress way I pass through between yesterday and this afternoon no small" Tolu said exasperatedly.
" Sorry. You still get time to do your registration now. Na the fact say everyone dey rush to do the registration before deadline cause the problem with the portal" Hassan said to Tolu.
"Eh na. Everyone shock say dey still release the news say the deadline na today. Seriously, deep down in my heart I dey still believe say them go extend am but when I see that release, Omo I start to dey panic. The portal Kon spoil day for pesin. The stress no good at all. If you know the amount of time I enter Keke maruwa from Sub go gate because of this portal issue ehn. But sha, I thank God say them shift am" Tolu said.
" Na most people dey happy about that. We go dey alright for this school sha" Hassan said.
"Abeg I wan go eat and sleep. I dey tired like this" Tolu said as he proceeded to the kitchen to get his dinner.
" Omo, we go dey alright for this school" Hassan said as he resumed back with his assignment.
0 Comments