Ticker

6/recent/ticker-posts

Header Ads Widget

Responsive Advertisement

Pidgin story -- My School and I; Bet goes wrong

 My school and I: Football; Bet Goes Wrong

 

"Man city no fit win jhoor" Hassan said firmly.

"Abi na. See the players now, Gabriel Jesus no dey there, Kun Aguero,Raheem Sterling. Omo this match no dey look favourable for una at all. At all" Tosin said to John.

"Na wetin I dey tell him be that o. E still dey argue. Them kon even change una setting for you. How you think say you people go win? You no see Neymar,Mbappe, Angel Di Maria. PSG players dey complete na. Una no even complete" Hassan said.

" Ehn I sabi sey we no complete and the fact that our good players no dey play with the way them come change the formation, fit make us loose but no let us jump into conclusion yet. Make we see how e go, go. We fit win at the end" John replied.

"Pele die hard fan. PSG go flog una go home. Una go cry home. You sabi how you dey always spoil face when you dey angry? Na so you go do" Tosin said laughing at John. The match was really not looking favourable for Man city.

"Na you sabi o. My own be say we fit win" John argued.

"Mtchew. Wetin you dey talk sef? Shey make we bet?" Hassan asked.

"I no dey bet jare" John said with disinterest.

" Ehn ehn. Na because you no say e no sure for you sey you go win, you no wan bet. Mtchew. una go cry go home today" Hassan said laughing at John.

"Na you sabi. But we sha fit win no dey buga yet" John said.

"Anipe make we bet?? Let's bet now" Hassan said.

" Oya sef, how much?" John asked

" 5k" Hassan replied.

" Haba! shey that wan no Kon much?" John questioned.

"Oya 3k nko?" Hassan offered a new option.

"Ehn I think say I get 3k" John said in agreement

"Tosin you no go join?" Hassan asked Tosin.

"Me Ke? Na pesin wey get money dey bet o. The two of you na olowo na. As I dey now,I no dey your league" Tosin said.

"You dey always dey broke n'tie. John, Oya go bring your money. Me sef go drop my own now" Hassan said.

"Hmm. When una dey see this moneyyy??" Tolu questioned sarcastically.

"We say make you no get moneyyy?? Hassan questioned back sarcastically.

"I dey come. Make I go bring am from my room" John said as he exited the room for his room"

"And I dey laugh for John o. Na my gain sha" Hassan said confidently.

"No too laugh yet sha. E fit win the bet. But me sef doubt say Man city go beat PSG" Tosin said.

"Na it be this" John said as entered the room.

"Give Tosin make e hold am for us. So e go be the one to give the pesin way win, 6k like that. But if e be draw draw. We go collect our 3k back. Shey you get?" Hassan asked.

"I get. No wahala na" John said in agreement.

"Una be ritualist. Na ritualism you dey do. For this hard time una still get 3k for hand?? Ehn?? Olorun o! see the 6k wey no dey my account in my hand and my own money remain ₦50. Owo temi ti ku wazo. Ah!!" Tosin said sarcastically as e counted the money over and over again.

"Abeg no dey whine. Ritualism ko" John said waving off Tosin's attempt to pull their legs.

" No tear that money o with the way you dey look am, dey count am again and again" Hassan said to Tosin.

"The money dey plenty ni. Odin din 6k. siz-kay for this hard time. Why you no Just dash me the money?" Tosin asked them.

"Dashboard ni" John replied laughing.

"Abeg make we dey watch the match go jare" Hassan said.

....

"Una still dey draw sha. 1-1. E be like say nobody go win extra 3k go home like this. Una go collect your money back" Tosin said as he continued watching the match on his phone.

" E better sef I no wan lose my 3k jare" John said.

"You no even get faith say you still fit win" Tosin said to John.

"E no sure again for him but" Hassan said.

" Let's still they watch. PSG still fit score" Hassan said with full concentration on the phone screen.

"GOAL!!!!!!!!!" John screamed jumping up.

"Yes! Yesss!! 1-2. 1-2 oo" he said with joy "Ope o"

" Omo dey score sha" Tosin said grinning.

"Shey we no win??? Shey we no win???" John questioned joyously.

" Why Hassan come freeze for chair?? Tosin asked laughing at Hassan who was staring at the phone without moving.

"E choke am ni" John said laughing.

"E choke?? E choke?? Baba no wan believe" Tosin said mocking Hassan.

" Who dey breeet like this? Omo! I know no say I go really win this thing o. Ope o" John said jubilating.

" Guy sorry ehn. There's time for everything. Time to lose and time to win. It's not just your time. Pele shogbo" Tosin said laughing while patting Hassan on his back.

"Wetin sef? shebi Na still first leg be this. Abeg free me" Hassan said as he shook Tosin's hand off his body.

"Peleee. Whether e just be first leg whether e no be first leg I don win the bet already. Tosin abeg my 6k? John said stretching his hand out to Tosin.

"You wan collect am for real?? Shey be Na play play bet Na??" Hassan said with a sad expression.

"Play play Ko" Tosin said laughing. " This guy funny sha. No be you say make una bet?? E Kon win the bet you sey Na play play. Mtchew. Abeg, John take your money jare" Tosin said, giving John his money.

"Omo I don see money wey I go use chop this week. Ahh I even wan sub for class sef. Hassan thank you. Thank you for persuading me to bet o" John said as he joyously, proceeded to exit the room.

" Ahh. John u don dey go? na the money wey Aishat give me make I hold for am o" Hassan said to John

" Wetin be my own? Who bring bet? Why you no think am before you bet? abeg. Tosin bye bye jare" John said exiting the room.

"Ahh mogbe" Hassan said with his hands on his head.

"Shey no be the money Aishat say make you keep for am sey she wan use am sub for virtual class, be that? Tosin questioned laughing.

"Na the money o. She say she no one spend am Na why

She say make I keep am" Hassan said with his hands still on his head.

"Ah! your own don reach you" Tosin said laughing hard.

"No dey curse please. My own no go reach me, abeg" Hassan said hissing.

"You go know. Your sister way no get chills. You go use her money bet. You don forget say she no dey joke with her school work abi?" Tosin questioned.

"I no forget now. All my mind be say Na me go win the bet and if e Kon even happen say I know win the bet I go go withdraw for am tomorrow before she go come collect am or las las I go do transfer for am. Ah!" Hassan exclaimed as he explained to Tosin.

" Wetin kon happen? Shebi you suppose still get like 12k for account?" Tosin asked.

"Ehn Na wetin I dey think before be that. But Na now now I remember say I don give kolade 11k make e help me bring the Nike Air force wey I see for e status yesterday o. Ahh!! Mo je gbese" Hassan said bitterly.

"Olowo!!! (Tosin hailed) You go buy 11k shoe. I talk am say I suppose to dey respect you for this room. But you no get sense sha. You just dey first class ni. The wey you dey think sometimes dey always surprise me. You sha always like shooking your head inside trouble. Why you go by shoe? How many shoe you wan wear sef? All the one way you get never reach you? Abi you wan dey wear them together? You just get problem sha" Tosin said laughing.

" Wo, that one no be Koko now. Na how I go get 3k give Aisha tomorrow dey important now. That girl go roast pesin with talk. Ahh olorun o" Hassan said with worry written all over his face.

"Boya you should explain to her and do 1k sub for her" Tosin said mocking him.

"Ah 1k sub? You know no my sister. Mtchew. Shey you fit borrow me 2k? I promise say I go give you back immediately I see money. Abi you go help me sub for her? I go pay you back.

"Sub-zero ni. Mtchew. Shebi you say I dey always dey broke? Ehn ehn naso e be like that. As I dey like this owo ti ku wazo. Even if I wan help you I no fit cos na the money wey I wan use sub and eat this week dey my hand"

" Ahhh!! Which kind thing be this now? Aisha no go let me hear word with this thing wey I do." Hassan said bitterly.

" You fear your sister like that?" Tosin questioned mocking him.

"That girl dey always dey dramatic jare. She fit report for màlè like that" Hassan said hissing.

"Omo! Sorry ehn. You go dey alright" Tosin said.

"Ah! Why I go bet??" Hassan questioned rhetorically.

"E no be your fault like that. Me sef no expect say Man city go win but surprisingly they did. Na John luck be that. Wo, I dey go Ibrahim room go read jare. Man gats to Jack. Exam go soon start" Tosin said exiting the room.

 

Post a Comment

0 Comments