MY SCHOOL AND I: BAD NETWORK!!
"You don see network" Tolu asked Hassan who was moving around the room to get connected to his zoom class.
"Mtchew. I no see o I no see" Hassan said as he was getting frustrated with the bad network.
"Move that side, maybe you go see" Tolu said to Hassan.
"I don go there, network no dey there" Hassan said moving around.
" Wetin you dey do? Why you dey climb table? Tolu asked Hassan as he was amused at Hassan's action.
" Wo e be like say network dey this fan side" Hassan replied
"Fan side?? Shey you dey okay sha? Tolu asked laughing. So na for ceiling network dey? Why you no climb the fan instead? Mtchew. You no know wetin dey do you. Tolu said laughing.
"Ahh this thing should connect na" Hassan said in frustration.
" I no know why you too go sub for GLO" Tolu said hissing.
" Them dey always give someone free mb well ni. E pay me with this virtual class we dey do sef. MTN no pay me dat much jare" Hassan said.
" Wetin be the point if their network no go dey good? Tolu questioned.
"E no really be like that o. If you dey area wey Glo dey work well , you go enjoy am. I know no wetin happen to dem this morning and e no dey do like this before o for this area" Hassan replied exasperatedly.
"Sorry o, eyan GLO. Until dem go wahala you with their network at the wrong time" Tolu said.
"E no go happen jare" Hassan replied.
"Go outside na. Network fit dey outside" Tolu said
"E don connect o. E don do" Hassan said with joy.
"Adupe" Tolu said
" Omo them don dey do test o!! Hassan exclaimed.
" Una don dey informed about the test before? Tolu asked.
" No o. Lecturer say na quick test" Hassan replied.
" How many marks?" Tolu asked.
" 10 marks o" Hassan said typing away on his phone
"You don see the question?" Tolu asked.
"Ehn. One pesin don send am for chat" Hassan replied Tolu as he continued with his test.
" Okay" Tolu said.
"Ahhh!! ahhh!! ahhh!!" Hassan exclaimed.
"Wetin?? You no know the question?" Tolu asked
" Ahh!! GLO!! Make una no make me swear for una o!! Ahh!! GLO no do this now. Let me submit first o. Connecting ke?!! Ahh Ahh!!" Hassan exclaimed
"E no connect again? Tolu questioned.
"E dey load ooo. Ah! mo shi network lo o (I used the wrong network)" Hassan said with is hands on his head.
" Abi which kind thing be this na??? When lecturer kon say 5 minutes remaining. Ah GLO I fit swear for una o" he said in annoyance
"Omooo!" Tolu said, laughing hard.
" Guy e no funny at all. 10 marks dey on de line Na. Ah GLO!! Una don fuck up o" Hassan said annoyed.
" Wetin? Na me carry network go? Mtchew. On this thing jor make I share you hotspot, make you quickly submit wetin you don type" Tolu said
" Ah Guy, God bless you. My gee!! Oshey Omo mi. My gee!!" Hassan said hailing Tolu as he turned on his WiFi.
Testimony
0 Comments