MY SCHOOL AND I.
#Episode 1 : Dehinde; Virtual class no go do us something.
Hassan: Guyyy!! you know hear wetin sup for school?? (Hassan asked Tosin as he entered the room)
Tosin: Wetin happen? (looking worried)
Hassan: Ahhh you no hear about the person wey go insult e lecturer for zoom class?? Wetin be e name seff? Hmmm" (trying to recollect)
Tosin: Shey Dehinde?
Hassan: yes yes na the name be that. You don hear already sef
Tosin: No o. I never hear. Mtchew. The news wey don go viral since, your own station just dey show am. When e be se, you go dey freeze twitter and WhatsApp for phone. Na for only class, you go unfreeze WhatsApp. After, you go still freeze am back sey you need space for phone and you wan manage data. How you wan take dey updated? Mtchew. Abeg shift" (pushed hassan out of his way and went to the toilet).
Hassan:Na you know. You kon dey use style style insult me abi? no worry o. You wan go baff?.
Tosin: No o. I wan go look for dehinde (Tosin said hissing, as he proceeded to open the door to exit the room. He was obviously not interested in the matter that already trended for days now).
Hassan: But, Wetin e chop go class that morning sef?
Tosin: How I wan take know?
Hassan: Omo. Dey say the guy para gan for the chat o.
Tosin: the truth be say na wetin dey many students the guy na
Hassan: how you take know say na boy? because na ruth be the original owner of the matric number o
Tosin: na wa, everyday with different tori. you hear the afas data gist too. e be things truly. student pay for 10gb na 8gb dem give them. where them con hide the subsidy?
Hassan: haqhaqhaq. o boy, this semester na season film, e long well well well, from management telling student to drop number for data, to lecturer on zoom with "can you hear me'', abi lecturer wey go just do 1hr voice note for whatsapp, dehinde matter sef no carry last, now afas. wetin go happen tomorrow like this?
Tosin: e fit be lms go crash.
(Tosin and hassan laughed while they both walked out to buy foodstuff)
0 Comments