My School And I; We Go Run Am Smooth
"Ooo! Mtchew" Hassan hissed.
"Ooo. Me I no get again o. Ah"
Hassan complained to himself.
"Ooo!!! Mtchew" he hissed, slamming
his pen on the table.
"Ahn Ahn. Wetin? Why you bang the
table like that? You just dey hiss, dey complain anyhow?" Tosin said, a little
pissed at Hassan.
"Na the zoom class wey person dey
do jare. I never even write the point way I want write before the man talk another
one. I just dey lost. This online thing don dey tire me jare." Hassan lamented.
"The class don end sef. Mtchew. See how points dey scattered" he said
hissing.
"Sorry. Na because of this I prefer
may lecturer drop voice note of the lecture instead of zoom class. Pesin no dey
always fit jot point well for all this zoom and telegram classes. Na only if the
lecturer repeat am abi e dey say am make you write am down, you fit see something
jot well" Tosin said.
"No o. Voicenote wo? Abeg. I still
prefer zoom or telegram voice chats o. Voice note way go long like giraffe neck.
Abeg. 30 minutes voice note lasan, you fit use 1-2 hours write down the note. If
you con get lecturer wey dey always drop one hour voice note. Na dere you go hear
wen. You fit use 3 hours write down the note. Mtchew" Hassan said.
"As in ehn.. that thing dey always
vex pesin. If e con be like that lecturer wey John dey complain about, you go hear
wen." Tosin said laughing.
"Which lecturer be that? Cos me sef
borrow two course from e department" Hassan said.
"Ehn ehn? Efiwe!! I know no say you
borrow from the department o. E say the lecturer dey always speak grammar too much.
I remember the day wey e dey lament for here. E just dey hiss every minute e dey
listen to the voice note ni. I just dey laugh at him ni" Tosin said laughing.
"Ahhh.. I know that lecturer. Na
d truth e talk. That lecturer grammar dey always much. The one way you don hear
o, the one way you never hear. The thing e go dey explain go dey simple o but the
English wey go use construe am ehn. If you hear am your head go first fly away.
Pesin go dey get headache because of voice note. Mtchew" Hassan said.
Tosin bursts into laughter "Omo!
Na wa o"
"Mtchew. In fact, I don dey already
think boya I should drop the course. I just change my mind say all I need to do
is filter the grammar and get the thing wey e dey explain. But the stress to write
down the notes with the grammar, still dey there. But we go dey alright sha."
Hassan said.
"Abi na. Ehn, make una tell the lecturer
say you want una classes for zoom or telegram voice chat na." Tosin suggested.
Ehn??! Me I don't know how the zoom class
or voice chat go take be o. Cos how pesin go fit jot well?" Hassan asked.
"E go still better Na. At least if
e mention one-word wey you no understand. You fit tell am to explain am for una.
You fit still even record the class, go listen to am later. See na all of them get
their own wahala jare. The virtual class sef, stress ni. Oti fe su mi" Tosin
said in frustration.
"As in. E don dey choke. Everything
na Desmond Elliot fault jare. Na him cause this whole stress" Hassan said sarcastically.
"Ah, you never chop. You sef don
join them. Una no well. Any small thing na Desmond Elliot cause am, Na Desmond Elliot
cause am. SMH" Tosin said hissing.
"Shey no be him?" Hassan asked.
"How e cause this whole virtual class
stress ehn??" Tosin replied with a question.
"I no know. Na him sha cause am"
Hassan replied.
"You no well" Tosin said, shaking
his head.
"Wo, wetin dey do me no dey do you.
I get like 3 assignments wey go due in 2 days’ time and I never do anything. I still
get voice notes wey I go listen to o. Notes still dey there to complete o. Ahh!!
These things don dey too much." Hassan said exasperatedly. "Abi I should
go and be selling suya ni? Shey you go join me? Make we start the business, sharply
sharply. Money dey dere o" Hassan said laughing.
"Hmm. E dey look sensible jare. Atleast
na only night pesin go dey work. Money go also dey. Pesin no go dey broke. Abi we
should drop out?" Tosin asked.
"You and who be the "we"
?" Hassan questioned.
"Me and you naa" Tosin replied.
Shey you dey okay so ? I tell you say
I wan drop out? If you wan drop out, drop out jejely, no dey tag me with dropping
out again. Abeg. Me I know go drop out o" Hassan said.
"Ah Ahn . Shey no be you say make
we start suya business ni??" Tosin asked laughing.
"When I come say am nko? Shey I mention
or I tell you say I wan dropout?" Hassan questioned.
"Ahh!.. wetin you kon mean by that
if no says we go drop out?" Tosin said laughing.
"I know mean am that way. Please."
Hassan said hissing.
"Pele o," Tosin said.
"Wo, no stress me jare. My head dey
calculate how I go finish these assignments on time. Why school con dey hard like
this ehn? Make dem just extend this semester, abeg. I cannot can anymore. My tired
is tired, fa" Hassan said in exasperation.
"I hear sef say e possible wey go
soon resume physical classes and say, dem fit extend this semester for some weeks"
"Ehn ehn? Ahh! thank God o. Ahh!
almighty God thank you" Hassan said with joy.
"Calm down. E no sure yet. But e
dey highly possible sha. E be like say dem still de deliberate am" Tosin said.
0 Comments